Banner Image

All Services

Writing & Translation Articles & News

Tears as son wey loss for market since 2

$25/hr Starting at $25

Parents of some of di 15 pikins wey police for Rivers State Command rescue from alleged child traffickers for Aluu, Ikwerre local goment area of Rivers State dey thank God say dem don reunite wit dia children.Na on Tuesday 6 September 2022, di Rivers State Commissioner of Police Friday Eboka tell tori pipo say men of Operation Restore Peace storm hideout of alleged child traffickers for Omuigwe Abuja II for Aluu, Ikwerre LGA and rescue 15 pikins from one 44 year old Reverend Sister.One of di parents wey tok to BBC Pidgin say e don reach two years since her son loss for Kpansia market Yenagoa, Bayelsa State so she surprise and happy well well wen she see her son alive two years later.Na on sunday 4 September 2022, she get di news say her pikin wey don loss for two years don return.She tell BBC Pidgin say she bin dey church wen her neighbour run come tell her say police don bring back her son all di way from Port Harcourt so make she come see am."Na so I run come house come see my son with di Police pipo. Dem bring am come my house for Yenagoa.”She say e don reach two years since her son loss as na for October 2020 her son disappear as dem allegedly kidnap am wen im bin dey seven years old but now im don turn nine years old."I wan thank di police for dia effort, I thank dem for dia work well done. I thank Almighty God wey keep my son alive for me to see am again. Since 31st October 2020 dem [allegedly] tiff am for Kpansia market for Yenagoa." She tok.

Anoda mama say dem kidnap her nine year old daughter four months ago for Ojukwu-diobu field for Nsukka Street, Mile One Diobu area of Port Harcourt, wen she send her to go collect yam peels wey dem go use feed goats from pesin wey dey supply dem for di market."I send her go market to bring yam peels for goat becos we dey take care of goats, so she go di market with her senior sister.“Wen dem reach dia, dem no see di woman wey dey keep di goat food so one man tell dem to sidon wait small.“As dem dey wait, dem allegedly see dis woman [di Reverend Sister] with oda two pikins. Di man come send di senior sister message, as she go di message naim dem get chance kidnap dis small one.“Dis month make am four months since dem [allegedly] kidnap her and we don dey look for her since dat time, even make police report say she dey miss.“Na dis Saturday police discover dem but na on Sunday I see her.“I bin dey church wen my son run come tell me say dem don see dia sister. I take excuse from church come house but dem direct me to GRA Police so I go dia.“My daughter naim first see me as I reach di police Station, na so she run come dive me, call me mummy! I come hold her. I dey very very grateful to di police. Goment police dey do dia work. I thank dem.” Na so she  tok.For di papa of one of dem wey loss since April, 2022 , e say im shed  tears of joy wen im reunite with im pikin and e no get words to thank God and di Police wey bring back im eight year old daughter back to am.

About

$25/hr Ongoing

Download Resume

Skills & Expertise

Article EditingArticle WritingJournalismJournalistic WritingNews WritingNewspaper

0 Reviews

This Freelancer has not received any feedback.